Waka go wie?
Yo iye de wok so?
yu no si wetin de shele?
hie wetin de folo?
hu wan ‘‘wait’’ mek i
puo fo im hed?
I no go puofo mai hed
a no go du smesme fo dis mata
A don de si wetin de hapun
dem de se notin de hapun
na hu bi ozugbo
we dem go hol im han waka
desho “road” fo eria waka
wemanpikin don pas tete
I no go puofo mai hed
A no go du smesme fo eni mata
Mai iye de kakulet
mai ai de waka
fo dis ples wie abracadabra
dedansajasko
fo dis ples wie hu no go, no nou
hu de get, de get, Hu no get, no de get
fo dis ples wie monki de pakej fo monki
monki no gri send monki go prizin
Dis ples no bi odinari ples
no bi ples fo pipul we no get ples
na fo pipul we nou wetin de
wen wota de ron, tins de flo
fo evribodi we nou wetin de
fo pipul we get liva to si di flo
As tins de bi “rain de skata”
as tins de bi “sun de trowe”
as tins de bi “laif don keke”
as tins de go “laif de swit”
hufol an get op na im bi pesin
na so a de ask “waka go wie?”
________________
Tatafona mai nem
A go tok di won a si
a go tok di won a no si
laik se a de fo insaid “sea”
Mai nemnaTatafo
a go yan wetin no de
laik se na onli mi de
Mai nemnaAproko
a go du am as a laik
ivun if a no bi koko
Dem se a de yanopata
a de yan wetin no konsain mi
mai maut de raiv pipul enta “sea”
dem go si Amebo fo propaopata
Mai nemnasabisabi
A don enta levul fosabisabi
mai maut fit kot somtin into tu
mi na koret olofofo
A fit du oturugbekefo eni ples
a don koskasala fo plenti ples
a get nem fo plenti langwej
mai oda nem na oturugbeke
a no send hau yu tek am
___________
Edwin Eriata Oribhabor na Author, Abuja na Kpangba an oda Puem-Dem an Editor of If Yu Hie Se A De Prizin – antoloji of puem-dem fo Naija langwej