SUFFERING AND SMILING
We hold these truths to be self-evident:
That where there is a child
There must be a cane.
That before you make ends meet
There will be some pain.
That Lekki is the part of Lagos
Closest to heaven.
That after such a brutal week
We deserve a good wedding.
That Fashola does the work,
Tinubu dey behind am. (2009)
Tinubu dey jealous am.
That Allahu Akbar
No dey disturb Revival.
Say do me I do you
God no go vex.
Say jazz pass jazz
Na so sense pass sense.
Say my people for village
Never sabi Rat Race.
If no be for football
Man pikin for don crase.
One Nation under Fela,
we dey suffer, dey smile.
“Eko o ni bajẹ:”
this town no go spoil.